Showing posts with label PIDGIN NEWS. Show all posts
Showing posts with label PIDGIN NEWS. Show all posts

Thursday, 20 August 2026

DORIS OGALA SAY "NOTHING GO STOP ME MAK I NO BECOME ABIA GOVERNOR FOR 2027"


AAC Abia governorship candidate Doris Ogala says nothing will stop her from becoming the next governor of Abia State in 2027.
Designed by ZpotHub News 


UMUAHIA — Abia people, mak una hear this one well well.


Nollywood actress wey turn politician, Doris Ogala, don come out again tok say nobody fit stop am. She say by 2027, she go sit for Abia Government House as governor.


Ogala dey run under African Action Congress, AAC. She yarn this one on Monday, August 18, 2026, when she dey gist about her plans for Abia State.


And according to weytin she tok, this thing no be joke. She call am "God work." She say na divine mandate, say na God send her to come rescue Abia people.


'NOBODY FIT STOP ME'


Doris no dey hide am. She tok am straight.


She say her decision to contest no be because say she just wan try luck or because she dey find fame. She say na her calling.


"My mind dey strong. I know say I go become the next governor of Abia State," she tok. 


She know say politics no easy. She know say e go get fight, e go get wahala, e go get people wey go tok say "na actress she be." But she say all those one no dey her mind.


"Nothing go stop me," she repeat am.


Ogala say she wan enter government house to bring change. She say she don tire to see how ordinary Abia people dey suffer while small group of people dey chop the money.


She present herself as the person wey go come wipe Abia tears.


'ABIA NEED RESCUE'


If you ask Doris wetin she wan do for Abia, she get plenty things for mouth.


Her main focus be how to mak life better for the man wey dey sell gala by roadside, the woman wey dey sell pepper for market, and the graduate wey dey house with no job.


She don list her key areas:


First na jobs. She say Abia youths dey waste. Too many graduates dey roam street. She promise say she go create opportunities so that young people go fit get work and mak their own money.


Second na education. She tok about better schools, better teachers, and say government must invest in pikin future. 


Third na health. She say hospital for Abia need to work. Ordinary person suppose enter hospital without say dem go ask am for 200k before dem touch am.


Fourth na road and infrastructure. "How you go tok say you be governor when road full everywhere na pothole?" she ask. She promise say she go fix road and mak sure say light dey stable.


Last na good governance. She say transparency must dey. Say government money no be family money. Say people must see wetin government dey do with their money.


"Government suppose work for people, no be say people go dey work for government," she talk.


SHE GO MEET GOVERNOR OTI FOR RING


Now here be where the matter dey sweet.


If Doris enter 2027 election, e mean say she go enter ring with the current governor, Alex Otti.


THIS MIGHT INTEREST YOUSTATE POLICE BILL: FG TOK SAY 5PM TODAY NA DEADLINE FOR UNA TOK TOK


Otti dey rule Abia now under Labour Party. Since he enter, people dey tok about the changes wey dey happen for Aba and Umuahia. Road dey get fixed. Garbage dey comot. 


So 2027 go be big fight. 


On one side na Otti wey go say "mak una give me second chance to finish my work." 

On another side na Doris Ogala wey go say "mak una give new face a chance. Mak una try something different."


And no forget say other parties go bring their own candidates too. PDP, APC, APGA, everybody go dey there.


So Abia 2027 election go hot. E go be like Action movie.


'ABIA HAS NO CHOICE'


This no be the first time Doris dey tok big.


Back for July, during TikTok Live, she come tok something wey trend. She tell Abia people say "Abia has no choice."


People vex, people laugh, people support. But she no gree shift.


She say the reason why she dey so confident na because she believe say God already choose her. 


"Na God send me. Na divine assignment," she tok again for this new statement.


For her, that belief dey give her courage. Even when people dey doubt, she dey talk say the mandate dey her hand already.


FROM MOVIE LOCATION TO GOVERNMENT HOUSE


Mak we tok truth. Most people know Doris Ogala from Nollywood.


She don act for many movies. People see her for TV, they clap for her. Now she don leave camera won enter politics full time.


For May 2026, AAC do their primary election and Doris win. That mean say she no be just aspirant again. She be the official AAC candidate for Abia governor 2027.


That na big step. From acting script to reading budget. From movie set to campaign trail.


Some people go say "wetin actress know about governance?" But Doris dey answer them already. She dey tok about policy, she dey tok about people, she dey tok about service.


Whether people go buy am or not, na 2027 go tell us.


WETIN SHE PROMISE ABIA PEOPLE


Mak we break am down simple simple.


Doris Ogala say if Abia people vote her, this na wetin she go focus on:


1. Jobs for youth. She want create programs wey go help young people start business, learn skill, and get employed.

2. Better schools. She talk say pikin for village deserve same quality education like pikin for town.

3. Better hospital. She want make healthcare affordable so that poor man no go die because of small sickness.

4. Good road and light. She say infrastructure na the foundation of any serious state.

5. Honest government. She promise transparency. Say every kobo must get account.


She no give full detail yet on how she go do all these things. But she say as campaign dey near, she go bring out her full manifesto.


For now, she dey use one message run: "I come to rescue Abia."


2027 ABIA ELECTION GO BE FIRE


2027 still far, but politics don start already.


Abia people dey watch. Dem dey ask questions. Dem dey remember wetin past government do, and wetin current government dey do.


Doris Ogala entry don add another color to the matter. Because she be celebrity, people go listen. People go follow her for social media. Her rallies go get crowd.


But election no be Instagram likes. Election na PVC. Election na who get structure for 17 local government. Election na who people trust to hold their money.


That na the real test for Doris.


She get name. She get voice. She get confidence. But does she get the ground? Does she get people wey go mobilize for her for Ohafia, for Arochukwu, for Osisioma?


We go see.


THE BIG QUESTION FOR ABIA PEOPLE


At the end, na Abia people go decide.


The question go be simple: "Who you trust with Abia for the next 4 years?"


Alex Otti go come talk about his record. 

Doris Ogala go come talk about her vision and "divine mandate."

Other candidates go come talk their own.


Doris own message clear: "Nothing go stop me. God send me. I come to rescue una."


Whether that message go enter people heart, na time go tell.


But one thing sure: 2027 Abia governorship race don start to dey interesting already.


Campaign never start full, but mouth don open. Posters never full everywhere, but gist don full town.


FINAL WORD


Doris Ogala don throw her hat inside the ring. She no dey play.


She say na God send her. She say nothing go stop her. She say she wan rescue Abia.


Now the ball dey Abia people court.


Make una listen to everybody. Make una ask questions. Make una no vote because of face or because of movie. Vote because of wetin the person go do for you.


2027 dey come. And Abia decision go matter.


Mak we dey watch as the drama dey go because as for ZpotHub News, our ear dey ground, our eyes dey focus for the abia game


Weytin be your take for this matter, drop am for the comment section,mak we reason am


By Solomon Emmanuel | ZpotHub News

Reporting from Umuahia

Thursday, 13 August 2026

STATE POLICE BILL: FG TOK SAY 5PM TODAY NA DEADLINE FOR UNA TOK TOK

By Solomon Emmanuel |Pidgin News



ABUJA — Omo, time don dey go o!


Federal Government don tok say today weybi Thursday August 13, 2026, by 5pm na the last time Nigerians fit tok their mind for the new National Policing Bill. 


The Ogbonge mata inside the bill na STATE POLICE mata.


Femi Gbajabiamila, wey be Chief of Staff for Oga Presido and Chairman of the group wey dey work on this bill, announce am yesterday say government won hear from everybody first before dem go carry the thing go next level.


So if you get anything for mind about state police, today na the last day. After 5pm, dem go close door.


5PM TODAY NA THE END


Mak I break am down well well.


Government say from now till 5pm today, any Nigerian, any group, any NGO, any traditional ruler, fit send their own tok. You fit tok wetin you like, wetin you no like, wetin you want dem add, wetin you won dem remove.


Na Why dem dey do this? Because dem know say this state police mata na big mata. E fit change how security dey work for Naija.


For years now, people don dey fight about am for TV, radio, Twitter, WhatsApp groups. Some people say "Yes, mak we get am." Some people say "No, e go cause wahala."


Now government don open door mak una tok. If you no to k today, you no fit complain tomorrow.


WHY PEOPLE DEY DEMAND STATE POLICE


Mak we look the mata from beginning.


Right now, Nigeria get only one police. Na Nigeria Police Force. The IGP dey sit for Abuja. All command, all order dey come from there.


If wahala happen for Sokoto, dem go call Abuja first. If cult people dey kill people for Port Harcourt, the DPO go dey wait for instruction.


State governments dey try help. Dem dey buy patrol vans, dem dey build police station, dem dey give money for fuel. But dem no get power to command the police.


The new bill won change that one. 


If e pass, every state go fit get their own police. Police wey governor fit tok to. Police wey know the area. Police wey fit speak the language. Police wey go reach crime scene in 10 minutes, not 2 hours later.


For many people, that one mak sense.


PEOPLE WEY SUPPORT AM DEY TOK SAY...


See, Nigeria problem no be the same everywhere.


For Borno, na Boko Haram and ISWAP dey disturb people.

For Zamfara, Katsina, Niger, na bandits dey kidnap school children.

For Benue and Plateau, na farmer and herder fight.

For Lagos, na traffic robbery and yahoo boys.

For South East, na unknown gunmen.

For Niger Delta, na pipeline wahala.


One police dey try handle all these different wahala. E no dey easy.


DIS ONE FIT SHOCK YOUUMAHI FIRE BACK WEYTIN NO GOOD: “OBI GO DEY ALIVE FOR 2027 BUT E GO LOSE TO TINUBU AGAIN”


People wey support state police dey give 3 main reasons:


Number 1: Quick Response

If police station dey inside your community, dem go hear gunshot and run come. Not say dem go dey Abuja dey hold meeting first. For village, 30 minutes delay fit mean 10 people don die already.


Number 2: Better Information

You go fit trust police wey be your neighbor. Police wey sabi your language. Police wey know say that okada man na cultist. People go fit give information freely because dem trust the officer.


Number 3: Governor go Answer

If state police misbehave, you fit vote out the governor next election. Right now, if police beat person for Enugu, who you go hold? IGP for Abuja no sabi you.


Professors, retired police officers, even some governors don talk say Nigeria don too big for one police. Dem dey point to America, dem get state police. Germany get am. India get am. Even South Africa get am. And e dey work.


Dem dey say: "Local problem need local solution."


BUT PEOPLE WEY DEY FEAR AM DEY ASK QUESTION


But wait first. No be everybody dey happy.


The biggest fear na politics.


People dey ask: Wetin go happen if governor use state police to fight opposition? 

Wetin go happen if governor say "Arrest that journalist wey write bad thing about me"? 

Wetin go happen during election if governor use state police to chase opposition party members?


That fear dey real because we don see small version of am before with some state security outfits.


People also dey fear other things:


Money Mata: Who go pay these new police? Federal Government dey owe salary already. If 36 states start to pay their own police, where the money go come from? Rich state like Lagos go get fine police with new cars. Poor state go get police wey no get boot. Is that fair?


Training Mata: Who go train them? We no want situation where police for one state go dey torture people, while police for another state dey professional.


Who get Power: If state police and federal police meet for one operation and dem disagree, who go get final say?


Tribe Mata: Some people fear say governors fit employ only people from their own tribe and state. That one fit cause more division.


All these na serious question. And na why government say make una come talk.


FG SAY MAK UNA TOK BEFORE WE DO ANYTHING"


Gbajabiamila talk say government no want do this thing in secret.


He say dem want make the law reflect "wetin Nigerians really want and wetin go work for our country."


So dem dey specifically ask people to talk about:

1. How we go prevent governor from abusing state police

2. How we go fund am

3. How we go recruit and train them

4. How state police and federal police go work together

5. Wetin be the role of community leaders and traditional rulers


All the messages, emails, letters wey people send today go help them amend the bill. Dem fit add new rules. Dem fit remove some parts.


WHY THIS MATA COME HOT NOW


Make we no lie ourselves. The reason everybody dey shout about state police now na because insecurity don too much.


Just this week:

- Bandits enter school for Kogi during NECO exam and carry principal go

- Navy rescue 13 people for Kogi road

- Police find 9 dead bodies for Niger road


For many places, when you call police, dem dey come after everything don happen. Sometimes dem no even come.


Mama for village go say: "If we get our own police for this community, those boys no go fit operate like this."


That na the pain wey dey push this debate.


IMPORTANT: STATE POLICE NO START TOMORROW


I need make una understand this one well.


5pm today NO MEAN say state police go start tomorrow.


No o.


Today na just "make una talk your mind" day. After 5pm, the group wey Gbajabiamila dey lead go sit down and read everything.


Then dem go take the bill go National Assembly. Senators and House of Reps go argue about am.


Then because police dey inside Constitution as "Federal matter," dem go need to change the Constitution. That one mean 24 out of 36 state houses of assembly must agree too.


That whole process fit take 6 months, 1 year, even 2 years. 


So calm down. But at the same time, no sleep. Today na your chance to tok.


WETIN GO HAPPEN AFTER 5PM?


Mak I tell you step by step:


Step 1: Dem go gather all the submissions

Step 2: Dem go use una advice to change the bill

Step 3: Dem go carry am go National Assembly 

Step 4: Dem go change Constitution if dem agree

Step 5: If everything ok, then states fit start to form their own police


So governors, lawyers, police experts, human rights people, student groups, market associations — everybody get work to do in the next stage.


THE BIG QUESTION BE THIS


The main question wey we need answer na:


Can Nigeria get state police wey go protect us, without turning to governor private army?


That na the wahala.


People wey support am say: "We no get choice again. Insecurity don kill us. Make we try something new."


People wey oppose am say: "First go fix Nigeria Police. Give them money. Give them equipment. Train them well. Before you go create 37 different police."


Both sides get point.


MY OWN TOK AS FOUNDER OF ZPOTHUB


As person wey dey report news and as Nigerian, I believe say we need tok.


Mak we no continue for one system wey no dey work for everybody and mak we no rush enter new system wey go bring new wahala.


That na why this 5pm deadline dey important. 


If you be lawyer, write about how to mak law wey go prevent abuse.

If you be youth, tok about how to recruit young people wey no go corrupt.

If you be woman for market, talk about how quick you want police to come if thieves enter.

If you be traditional ruler, talk about how community go support them.


If you keep quiet today, dem go decide for you tomorrow.


HOW YOU GO SUBMIT YOUR OWN BEFORE 5PM


Government never give one special email for this, but usually you fit send to Office of the Chief of Staff or Ministry of Police Affairs.


Better mak you check official government website or news to get the correct address. Write your letter. Even if na one page. Put your name, your state, your phone number.


Write "PUBLIC SUBMISSION ON NATIONAL POLICING BILL" for the subject.


Send am before 5pm today. No waste time.


MAK WE TOK TRUE


State police fit be the biggest change for Nigeria security since 1960.


E fit mak our street safer. E fit mak our villages sleep well at night. 


Or e fit create new problem where governors go use police to oppress people.


Which one e go be? E depend on us.


E depend on the law wey we write now.

E depend on the safeguards wey we put now.

E depend on how honest we dey today.


5pm today na the deadline, Thursday August 13, 2026.


After that, lawmakers go carry am. But the foundation na wetin you and I go submit today.


Nigeria need police wey dey near. Police wey people trust. Police wey dey accountable.


Make we fight make we get that kind police.


Mak your voice count today.


I don tok my own but Sha we weybe ZpotHub News pesin go still put our ear down mak we hear weytin be the final Bill so we fit sama the tok for you





Wednesday, 12 August 2026

FORMA OGA PRESIDO OBASANJO, JONATHAN, OBI SAY NIGERIA DEMOCRACY DEY SICK, IM NEED BIG REFORM NOW



BAUCHI —As e dey hot now, Three big men wey don rule Naija before and one wey won rule come 2027 don come together tok say Naija democracy get serious sickness.


Forma Oga Presido Olusegun Obasanjo, forma Oga Presido Goodluck Jonathan and forma Anambra State governor, Peter Obi gather for Bauchi on Tuesday, August 11, 2026. Dem tok say if Nigeria no change the way we dey do democracy, the country go get wahala.


The meeting na 2026 Goodluck Jonathan Foundation Democracy Dialogue. Big politicians, civil society people, traditional rulers and other stakeholders full ground. Everybody com tok how Dem fit mak Nigeria democracy better.


BABA OBASANJO BLOW HOT: "THIS DEMOCRACY NO DEY WORK"


Baba Obasanjo no gree hide word. The forma Oga presido wey rule Nigeria twice tok say the democracy wey we dey practice today no be the real one again.


As per weytin e tok , "Democracy na government of the people, by the people, and for the people. But for Nigeria now, e be like say na government of politicians dem, by politicians, and for politicians dem."

Read More Article: SENATE COMMITTEE TO CONTINUE CONSTITUTIONAL REVIEW TODAY

Obasanjo say e dey worried because many Nigerians don lose faith for the system.


"Wen people no believe election again, wen people no believe court again, wen people no believe government again, say dat democracy dey insid danger," Im tok.


The forma Oga presido list some problems wey dey worry am:


1. Election wahala - Obasanjo say INEC need to independent well. "Election no suppose be do-or-die. E suppose be contest of ideas."


2. Weak institutions - He talk say National Assembly, Judiciary and other institutions dey too weak. "If institutions strong, even bad leader no go fit mess up."


3. Corruption - Baba say corruption dey kill democracy. "How government go serve people when politicians dey steal money wey suppose build hospital and school?"


Obasanjo warn say Nigeria no suppose celebrate democracy just because we dey do election every four years. 


"True democracy na when common man get food, when pikin get school, when sick person get hospital, when youth get job. Na that time we fit say democracy dey work," he add.


Baba call for constitutional reform. He say some parts of the 1999 Constitution need to change so that power no go dey only for Abuja. "Make we give state and local government more power. Make government come near to the people."


JONATHAN: "PEACEFUL POLITICS NA THE KEY"


Former President Goodluck Jonathan too talk serious thing for the event. Jonathan na the man wey organize the dialogue through him foundation.


Jonathan remind people how he hand over power peacefully in 2015. "I show Nigeria and Africa say power no be do-or-die. Democracy mean say if people vote you out, you go house," he talk.


The former president say Nigeria need institutions wey strong enough to protect democracy.


"When institutions weak, politicians go dey do anyhow. But when institutions strong, everybody go follow law," Jonathan explain.


He talk about 3 things wey Nigeria must fix:


1. Electoral reform - "INEC must get money, must get independence, and must use technology to make election transparent."


2. Political party reform - Jonathan say political parties don turn to shops. "Party suppose get ideology. No be say today you dey APC, tomorrow you dey PDP, next tomorrow you dey ADC."


3. Youth and women participation - "If we no carry youth and women enter politics, we dey waste our future. Dem be the majority."


Jonathan also beg politicians make dem dey peaceful. "We no need blood to win election. We need ideas. We need to convince people with wetin we go do for them."


Since Jonathan leave office, he don dey travel Africa dey help countries do peaceful election. He say Nigeria suppose lead by example.


"Other countries dey watch us. If Nigeria democracy fail, Africa democracy go get problem," he warn.


OBI: "NIGERIANS DON SUFFER ENOUGH"


Peter Obi enter the matter with fire. The former Anambra governor and 2023 presidential candidate talk say Nigerians don suffer too much.


"Nigerians deserve better," Obi talk with emotion. "We deserve government wey go think about poor man, not just rich man. We deserve government wey go build schools, not just buy private jet."


Obi say the current system dey favor only politicians and their families.


"How you go explain say government dey spend billions on lawmakers, but teachers dey owe 6 months salary? How you go explain say we dey borrow money to buy car for senators, but hospitals no get drugs?" he ask.


The Labour Party leader say Nigeria need to change from "consumption to production."


"We no fit continue dey import toothpick, import rice, import everything. We must start to produce. That na the only way poverty go reduce," Obi talk.


He list 5 areas where Nigeria need urgent reform:


1. Education - "If we no educate our children, we dey create future criminals."

2. Healthcare - "Health na wealth. Government must invest for hospital."

3. Security - "Nobody go invest where dem dey kidnap people every day."

4. Economy - "We must support small businesses. Dem be the engine of growth."

5. Fight corruption - "We must cut cost of governance. Nigeria no fit afford this expensive democracy again."


Obi tok say 2027 opposition parties need to come together.


"If we divide ourselves, APC go win again. But if we unite and bring one candidate with clear plan, Nigerians go support us," he hint.


Young people shout and clap when Obi dey talk. Many of his supporters wear "Obi-dient" shirts come the event.


DEMOCRACY UNDER PRESSURE: WETIN DEY HAPPEN


The three leaders talk like this because Nigeria democracy dey face serious pressure right now.


Problem 1: Cost of living

Food price don high. Fuel price don high. Many families dey find am hard to eat twice a day. People dey ask: "This democracy, wetin e do for us?"


Problem 2: Insecurity

Bandits, kidnappers and terrorists still dey worry many parts of Nigeria. People no fit go farm again. People no fit travel for night again.


Problem 3: Unemployment 

Millions of graduates dey house. No job. Many youth dey find way to japa go abroad.


Problem 4: Trust wahala  

Many Nigerians no believe election again. Dem say vote no dey count. Dem say court dey decide who win.


Civil society groups wey attend the meeting too talk. Dem say Nigeria need new Electoral Act. Dem say judiciary need reform. Dem say police need reform.


One civil society leader talk say: "If we no reform now, 2027 election go worse pass 2023."


2027 ELECTION: THE BIG FIGHT DEY COME


The Bauchi meeting get big political meaning because 2027 election dey just 18 months away.


President Bola Tinubu and APC don already start campaign. Oga Presido don talk say he want second term to "finish the job."


But opposition dey gather too.


Peter Obi don talk say he go run again. Other PDP leaders dey talk too. Even some people inside APC dey complain.


The biggest gist now be: "Will opposition unite?"


Some people say Obi, Atiku and Kwankwaso suppose work together. Others say make everybody run alone.


Obasanjo and Jonathan no mention any name, but dem talk say Nigeria need "credible alternatives."


"People must get choice in 2027. No be say na only one party dey," Obasanjo talk.


OBI MOVEMENT: STILL STRONG


Peter Obi still dey enjoy massive support since 2023 election.


For 2023, he contest under Labour Party and come third. But he win for 11 states and FCT. He get the youth vote.


Since that time, Obi no gree rest. He dey go churches, schools, markets dey talk about good governance.


His supporters believe say 2027 na their time. "2023 dem rig us. 2027 we go win," one supporter shout for Bauchi.


But critics say Obi need to build structure. "You no fit win with only Twitter and youth. You need party structure for all 774 LGAs," one analyst talk.


WHY THIS CALL FOR REFORM MATTER WELL WELL


The call from Obasanjo, Jonathan and Obi no be small thing.


Reason 1: Experience 

These 3 men don see government from inside. If dem say system get problem, we need to listen.


Reason 2: Timing  

Dem talk now because 2027 dey come. If reform no happen before election, the election go get problem.


Reason 3: Public mood  

Nigerians dey angry. Dem want change. If politicians no listen, people fit use protest or boycott show dem say dem no gree again.


Political analyst say if government follow even 50% of these suggestions, Nigeria go better.


"But the problem be say politicians no like reform. Reform go reduce their power and their money," one analyst explain.


THE ROAD TO 2027: WETIN NEXT?


With less than 2 years to election, political activities don hot.


*For APC:* Dem dey consolidate. Dem dey bring governors and senators together to support Tinubu.


*For PDP:* Dem dey fight internal wahala. Who go be candidate? Atiku? Or new face?


For Labour: Obi dey build coalition. Dem dey talk with NNPP and other small parties.


For ADC and others: New coalition dey form. Dem say dem want "rescue Nigeria."


The debate about democracy reform go likely be the main issue for 2027 campaign.


Candidates go ask: "Wetin be your plan for electoral reform? Wetin be your plan for economy? Wetin be your plan for security?"


THE FINAL MESSAGE


As the Bauchi dialogue end, one thing clear: *Nigeria democracy need urgent surgery.*


Obasanjo talk am. Jonathan talk am. Obi talk am.


The question wey remain be: Politicians go listen?


If dem listen, 2027 fit be the election wey go change Nigeria.  

If dem no listen, Nigerians go decide for ballot box.


For now, ZpotHub go continue dey monitor the mata as e dey go and sama you updates.


As Obasanjo tok: "Democracy no be destination. E be journey. And Nigeria journey never reach where e suppose reach."


Wetin una think for this call for reform? Sama weytin dey your mind for coment below 👇


By Solomon Emmanuel |Pidgin News

Report from Bauchi, Nigeria

UMAHI FIRE BACK WEYTIN NO GOOD: “OBI GO DEY ALIVE FOR 2027 BUT E GO LOSE TO TINUBU AGAIN”




ABUJA — Omo, politics don hot again o!


Minister of Works, David Umahi, don throw another political bomb. And this time, e direct am to Peter Obi.


Umahi talk say make una no worry. Peter Obi go dey alive com 2027. E go even contest. But according to am, “Obi go still lose to Oga Presido again.”


Ah! Una hear am abi?


WETIN UMAHI REALLY TALK?


The matter start wen Umahi dey inspect federal road projects for Ebonyi State.


Journalists ask am weytin Obi tok wey trend last week. Obi tok for interview say virtually everytin wey e dey do for living, government dey frustrate am. E even tok say if dem get chance, dem fit mak sure say e no dey alive before 2027.


Na there Umahi vex.


E say: “Nobody want Obi dead. E no mak sense. We all want am alive mak e contest this election and watch himself lose again.”


E add say wetin dey fear Obi be say e think South East na him own papa property because of 2023 election. Umahi call that one “accident of history.”


According to Umahi tok, the game don change. E say Tinubu administration don do plenty projects for South East and give South East people appointments. So many people for there don see say following Tinubu dey favor dem pass.


In short: “Obi go contest, but Tinubu go win.”


WHO BE PETER OBI FOR 2027 MATTER?


Make we talk truth.


Peter Obi no be small name again for Nigeria politics.


For 2023, e enter race under Labour Party and scatter everywhere. Young people, market women, tech bros, church people — everybody shout “Obidient!”


Although INEC announce say e come 3rd, Obi supporters no gree. Dem say the election get mago mago. 


But one thing dey clear say Obi build serious political base. 


Since that time, e no keep quiet. E dey talk about economy, insecurity, corruption, governance. Anytime food price go up, Obi go tweet. Anytime government do something, Obi go react.


So na why people dey ask: “Obi go contest again for 2027?”


Obi never officially declare. But everybody know say e dey prepare.


TINUBU OWN SIDE NOW?


Now mak we talk about the oda person for this fight: Oga Bola Ahmed Tinubu.


Tinubu win 2023 election. E beat Atiku and Obi. Since e enter, e don do big-big reforms.


1. Fuel subsidy remove - That one make fuel price jump from N185 go N600+ 

2. Dollar float - Naira fall, things become expensive

3. Tax reforms - Government dey try get more money


YOU FIT LIK DIS ONESTATE POLICE BILL: FG TOK SAY 5PM TODAY NA DEADLINE FOR UNA TOK TOK


Government people dey say “this reforms go help Nigeria go long road. We dey cut waste and save money.”


But critics dey shout “people dey suffer! Market women no fit buy garri! Transport don double!”


Despite the wahala, APC and Tinubu supporters dey confident. Dem dey say “by 2027, the reforms go start yield results. Economy go better.”


Na why Umahi talk say Tinubu get political strength to win again.


2027 POLITICS DON START EARLY


Omo, 2027 still far, but politicians don dey sweat.


Why? Because everybody know say this next election go be war.


For APC side: Dem want hold power. Dem dey say “make we complete 8 years.”


For PDP side: Atiku still dey there. Dem dey ask if e go contest again or dem go bring new face.


For Labour/Obidient side: Dem dey ask if Obi go run again, and if e go run under Labour Party or join coalition.


For NNPP side: Kwankwaso dey there too. E get Kano and North.


THE BIGGEST QUESTION: UNA GO UNITE OR NOT?


This na the koko.


For 2023, opposition scatter. Atiku collect some votes. Obi collect some. Kwankwaso collect Kano. APC just waka go with less than 40%.


But if for 2027, Obi + Atiku + Kwankwaso + others join body, e fit be wahala for APC.


But if dem continue fight themselves, Tinubu go just smile dey enter second term.


That na why Obi, Kwankwaso and Seriake Dickson meeting yesterday dey important. People dey say dem dey plan coalition. But coalition dey get leadership wahala already.


UMAHI WORDS DON SCATTER TWITTER


As soon as Umahi talk am, social media catch fire.


Obidients dey reply like this:

“Umahi na betrayal. E forget say e be PDP before.”  

“2023 dem rig. 2027 we go guard our votes.”  

“Tinubu reforms don kill people. Una go see for 2027.”


APC people dey reply like this:

“Umahi talk truth. Tinubu don work.”  

“Obi na noise maker. No structure.”  

“Mak him contest and lose again.”


Presidency own sef join. Bayo Onanuga call Obi “pathological and serial liar” say e dey invent stories to get sympathy.


So the drag don plenty.


BUT NA ONLY SOUTH EAST MATTER BE THIS?


No o.


Umahi talk about South East because e be son of the soil. E be former governor of Ebonyi.


E say because Tinubu dey do roads and give South East appointments, people for there don dey shift.


But politics no dey work like that. 


Yes, federal projects dey important. But people also dey look food price, security, jobs.


If market woman for Onitsha no fit buy rice, e no go matter whether new road dey. She go ask “wetin Tinubu do for me?”


That na the balance.


WETIN POLITICAL ANALYSTS DEY SAY


I talk to some political people yesterday. This na wetin dem tell me:


Analyst 1: “Umahi dey play politics. E wan show say e loyal to Tinubu. But to say Obi go lose again na too early. 2027 still far.”


Analyst 2: “Obi problem na structure. If e no join coalition, e go find am hard. But if coalition work, APC go shake.”


Analyst 3: “The real issue be economy. If by 2026 food price drop, Tinubu go get edge. If e remain like this, opposition go get chance.”


WETIN THIS MEAN FOR YOU AND ME


You go ask “na me dem dey talk about?”


Yes o. Because 2027 go decide plenty things:


1. Fuel price - If same government continue, wetin go happen?

2. Jobs - Which government get plan for youth?

3. Security - Who go fit handle bandits and kidnappers?

4. Dollar and Naira - Who get better economic plan?


So whether Umahi dey right or wrong, the decision go dey your hand.


THE TRUTH ABOUT ELECTION


Make we no lie ourselves.


For Nigeria, election no dey finish until INEC announce result.


2023 people say Obi go win. E no happen. 

2015 people say Jonathan go win. E no happen.


So Umahi prediction fit be correct. E fit be wrong.


Plenty things fit change before 2027:

- New scandal fit happen

- New alliance fit form  

- Economy fit boom or crash

- New candidate fit enter


UMAHI FINAL WORD


Umahi no apologize. E stand on him talk.


E say make Obi contest. Make everybody contest. But e believe say Tinubu get the numbers, get the government power, and get the South East support now.


E even drag Obi say “wetin he think say South East na him birthright?”


SO WHAT NEXT?


Now ball dey Obi court.


E go need to decide 3 things fast:

1. Which party? Labour Party or new coalition?

2. Who be VP? Rumor say e don pick Datti Ahmed-Baba today

3. Which message? “Tinubu fail” or “I get better plan”?


For Tinubu side, dem go need to show results. Roads alone no go do am. People want food, light, and money for pocket.


MAKE WE TALK TRUE


Politics na game. Today you dey top, tomorrow you dey down.


Umahi talk wetin e believe. Obidients go disagree. APC go clap.


But 2027 go tell us who get am.


Until that time, make una no fight. Make una register PVC. Make una dey watch.


Go get you PVC because your vote na your power.


So weytin una think? 

Umahi dey talk truth or e dey form? Obi go lose again or 2027 go be different story?


Drop your comment make we argue am well 👇


By Solomon Emmanuel |Pidgin News